How Reverend Father Mbaka show face afta protesters enta street for Enugu state say e “miss”

Reverend Father Mbaka as e show for Enugu

BBC
Reverend Father Mbaka as e show for Enugu

Reverend Father Mbaka di catholic priest wey pipo dey find for Enugu state don show.

May pipo bin dey fear say sometin do am afta e no show for service.

As di mata dey cause protest for di state, na so di Department of State Services (DSS) tok dem bin no carry di priest.

Wetin bin first happen

Followers of di Catholic priest and leader of di Adoration Ministry for Enugu, dey protest plus destroy tins for di house of di Catholic Bishop of di Enugu Diocese, Bishop Callistus Onaga, on top accuse say im sabi di where about dia leader Rev. Father Ejike Mbaka.

According to di protesters, di last place wey Father Mbaka tell dem say im dey go di Bishop house on Tuesday and since dat night dem neva seem am.

Protesters for Enugu Bishop house

BBC

So far di Bishop neva comot to tok anytin.

Father Mbaka don dey news dis past few days afta im cari prophesy say make Nigeria President Muhammadu Buhari resign.

But presidency respond to di prophesy say Mbaka dey attack Buhari becos im ask for contract but dem no give am.

Di moment wey di Reverend Father show

Afta some hours of protest, one Toyota Rav4 motor come drive enta di crowd of protesters.

Immediately, di protesters come dey happy and celebrate say Reverend Farther Mbaka don come back.

Most of dem come dey sing ‘oyoyo’ ‘oyoyo’ and later Reverend farther Mbaka come stand up from di roof of di car and wave di protesters.

How di mata take start

Members gada dis morning for dia Wednesday church programme for Adoration ground for dia usual church programme wen dem announce to dem say dem no no wia Father Mbaka dey.

For di announcement, dem say Bishop Onaga bin call Mbaka on Wednesday say im wan see am for im house. Since Mbaka go see Bishop im neva come back and nobodi sabi wia e dey.

Protesters for Enugu Bishop house

BBC

Na dis announcement make im followers para go di bishop house to ask am wia Mbaka dey.

As dem para tire for di bishop na im dem hear say di bishop no dey im hous.

Na so protesters carry march go Holy Ghost Catholic Cathedral, di Bishop parish.