NIN-SIM link registration deadline: FG extend data verification exercise to 30th June

Nigeria goment don extend National Identity Card registration for mobile phone subscribers for di kontri till di 30th of June, 2021.

For inside statement wey di Director of Public Affairs of di Nigerian Communication Commission, Dr Ikechukwu Adinde sign, e say dem don make significant progress in di NIN-SIM verification process as almost 54 Million pipo don obtain dia NIN and dis wan fit translate to up to 190 Million mobile numbers.

Dis extension dey come afta President Muhammadu Buhari bin ask dem to extend di deadline to 6, May, 2021

Na for November 2020, Nigerian Communication Commission (NCC) bin make am compulsory for everybody wey dey use SIM cards for di kontri to validate dia registration by linking dia NIN or dem go block di SIM.

Since di announcement, NCC say di number of pipo wey dey register for NIN every month don increase significantly to 2.6 million and dem don create about 3,800 centres available for enrolments and more still dey come.

Di Chairman of di Economic and Financial Crimes Commission EFCC say di NIN-SIM linkage go support di federal government to checkmate di activities of fraudsters and Internet-Jaguda pipo- alias cybercriminals.

Dr Isa Pantami wey be di oga of di Nigeria Communication Commission, NCC, say dem go make sure to make di process of NIN and SIM registration dey easy for subscribers.

BBC Pidgin don already torchlight how you go fit do your NIN registration and easy ways to link your NIN to your MTN, Glo, Airtel, 9Mobile SIMs. You fit check di informate for here === NIMC registration portal: How to link your MTN, Glo, Airtel, 9mobile sim with NIN