Omumma Mgbidi crisis: Gunmen attack Imo Govnor Hope Uzodima house set am on fire

BBC Pidgin don get reports of heavy gunshots for Awo-Omamma, Local Government Area, Imo State.

Local sources say dem also hear di gunshots for Omuma inside di eastern Nigerian state.

As at now police don block Mgbidi, Imo state where some destruction also happen.

Di gunmen also attack Govnor Hope Uzodinma house for Omuma inside Oru East Local Government Area of di state.

Video wey BBC Pidgin obtain dey show sey some parts of di govnor house burn with some cars and buses.

E also show at least one dead bodi for ground but e no dey clear how many pipo die, as at Saturday morning.

Imo State goment official wey confirm di attack say e happun at about 9am today, Saturday, April 24th.

A group of 15 pipo wey di official describe as hoodlums driving in a motorcade of three vehicles followed by a tipper wey dem load wit tyres, na im cari out di attack.

Declan Emelumba, di commissioner for information and strategy say na dem be di attackers wey invade di village house f di govnor inside Omuma, for Oru East.

Dem attempt to burn down di house but security operatives stop di attack for cross fire wey lead to some deaths, Emelumba add.

Omumma Mgbidi attack happun just hours afta Govnor Uzodinma visit President Muhammadu Buhari for Aso Rock Abuja.

Di place wia dis attack happun na three hours away from Owerri.

Govnor Hope Uzodinma still dey Abuja wen di attack occur, according to wetin BBC Pidgin find out.

Tori be say Govnor Uzodinma dey hardly sleep for Government House, Owerri.

And di Imo number one citizen dey always stay for im village house for Omuma wey di gunmen just attack.

Nobody know di motive behind di attack.

Di gunmen also go di Government House where dem chant some anti goment songs but dem no attack am.

E never dey clear who dey behind di attack but locals dey suspect di attackers to be members of di Eastern Security Network [ESN].

Di Imo state goment say di incident dey politically motivated and dem don order investigation into di mata.

Earlier dis month, di Nigeria Police Force say na members of di proscribed Indigenous People of Biafra [[POB] and Eastern Security Network [ESN] carry out di deadly attack for Owerri prison.

For di last incident, di gunmen attack Owerri, di Imo State capital where dem way lay the Police Headquarters and Federal prisons where dem set over 1500 prisoners free.