Rivers State local government election update: PDP win all di Chairmanship, Councillorship seats for Rivers local goment elections

Voting

BBC
Many poliing units experience voter apathy as many pipo no come out to vote

Di Peoples Democratic Party PDP don win all di chairmanship positions for di 23 local goment areas for di just concluded local goment polls wey hold for di State.

Chairman of di Rivers State Independent Electoral Commission (RSIEC), Justice George Omereji (Rtd) announce di winners for di chairmen of di 23 local goment areas and Councillors for all di 319 wards for di RSIEC Headquarters, come tell all di winners to carry di odas wey no win along to serve di pipo and work to develop dia local goment and di State.

“Winners and losers remain members of di same family, after election make una respect each oda work togeda to develop di State.”

Justice Omereji also thank all di security agencies for dia support to ensure peaceful and violence free elections.

Im come add say dem go give di certificate of return to all di winners on Monday, 19 April, 2021 by 12noon for di RSIEC headquarters for Port Harcourt.

Meanwhile, some political parties don dey protest di results of di local goment election wey hold for Rivers State, dem call for cancellation of di election results.

Di African Action Congress AAC as dem call for cancellation of di election say di election na big embarrassment to democracy.

For statement wey di State Chairman of AAC, Progress Ogbokuma Aselemi sign, im ask federal goment to scrap State Independent Electoral Commission as dem don lose credibility and neutrality to conduct elections.

Similarly, di Social Democratic Party SDP don also call for cancellation of di local goment elections wey RSIEC conduct. Dem also call for fresh conduct of di local goment polls with new Chairman of di electoral commision.