
National minute silence go mark di start of di Duke of Edinburgh funeral next Saturday around 3:00pm for St George Chapel, for Windsor, Buckingham Palace don announce.
Di arrangements, wey be wetin di duke want na sake of di Covid pandemic.
Di Duke of Sussex go travel from US to join other members of di Royal Family for di ceremony.
Eight days of national mourning go dey ahead of di televised funeral, wey go be ceremonial event instead of di large state affair wey dey usually associated wit di death of a monarch.
Prince Philip no go also do lie in state – where members of di public go fit view im coffin.
One tok-tok pesin for di Palace say: “As dis na time of sadness and mourning di coming days go be opportunity to celebrate a remarkable life.”
Only 30 pipo – dey expected to attend di ceremony as guests, di duke children, grandchildren and other close family – but Prince Harry wife, di Duchess of Sussex don dey advised by her doctor make she no travel for di funeral, di tok-tok pesin add join.
Earlier, royal gun salutes don happun across di UK and for sea to mark di duke death.

Di British Army use di World War One-era QF 13-pounder field guns wey dem use for di coronation as well as to mark di marriage of the Queen and Prince Philip.
Prince Philip, Queen Elizabeth II husband of 73 years, die on Friday.
At di age of 99, e be di longest-serving royal consort in British history.
Saluting batteries fire 41 rounds at one round every minute from 12:00 BST inside cities including London, Edinburgh, Cardiff and Belfast.

Royal Navy ships for sea, including HMS Diamond and HMS Montrose, fire di salute, as tribute to di duke, wey serve as naval officer during World War Two and also bin hold, among oda titles, di office of Lord High Admiral.

Di salutes show live online and on TV, as dem bin encourage di public to observe dem from home.

On Monday, di House of Commons go come back from recess one day earlier and sit to allow MPs pay dia tributes to di duke.
Dem neva announce date for di funeral. Union and national flags go fly for half-mast for all government buildings until 8am UK time on di day afta di funeral.
Di Queen don begin to consider changes to di funeral and ceremonial plans, sake of I current goment advice and social distance guidelines.