DMX: US rapper DMX don die at di age of 50

DMX

EPA

US rapper and actor DMX don die at di age of 50, five days after him suffer heart attack.

Di performer, wey im real name na Earl Simmons, bin don dey on life support for some time but him die with im family by im side.

Di family for di statement wey dem release say DMX “na warrior wey fight till di very end”.

“Earl’s music inspire countless fans across the world and his iconic legacy will live on forever.”

DMX former manager Nakia Walker bin describe di rapper as person wey dey “vegetative state” with “lung and brain failure”, dat na when report come out say im dey life support.

Who be DMX?

DMX, aka Dark Man X, na leading hip-hop performer wey collaborate with artists like JAY-Z, Ja Rule and LL Cool J.

Im get im stage name from di name of drum machine wey dem dey use for rap tracks.

Di chart-topping artist songs include Party Up (Up in Here) and X Gon’ Give It To Ya.

Im also act on screen, when im appear for films like Cradle 2 di Grave, Romeo Must Die and Exit Wounds.

Born in Mount Vernon, New York for 1970, DMX publicly battle substance abuse for years and im bin spend several periods for rehab.

Im be father of 15, DMX serve jail sentences on charges wey include animal cruelty, reckless driving, drug possession and weapons possession.

According to his family, DMX die on Friday for White Plains Hospital for White Plains, New York.