Usman Alkali Baba: Protection of kontri pipo be priority for President Buhari- Osinbajo tok as e decorate new Acting IGP

Nigerian Vice President Yemi Osinbajo don tok say safety and protection of all Nigerians remain a priority for President Muhammadu Buhari’s administartion.

Osinbajo tok dis afta e decorate DIG Usman Alkali Baba as di new acting Inspector General on Wednesday.

Di decoration ceremony bin happun for Aso Rock Abuja, and e dey come afta di President through di Minister of Police Affairs Mohammad Dingyadi bin appoint am to replace Mohammed Adamu on Tuesday.

Before im appointment, oga Baba be di head of Force Criminal Intelligence and Investigation Department (FCIID).

Dis na as Adamu Tenure bin don end for February afta e spend di 35 years im suppose spend for service but di president bin give am three months extension to continue.

Adamu bin dey for Imo state on top di Prison kasala wey burst dia wen di appointment news come.