Owerri prison break Imo state: IPOB, ESN members na im attack police HQ and prison – Police

Owerri prison

BBC

Di Nigeria Police Force say na members of di proscribed Indigenous People of Biafra (IPOB) and Eastern Security Network (ESN) carry out di deadly attack for Owerri, di Imo State capital on Monday.

Inspector-General of Police IGP Mohammed Adamu, say di IPOB and ESN members wey allegedly carry out di attack plenty well well and dem carry modern weapons such as General Purpose Machine Guns (GPMGs), Sub-Machine Guns (SMGs), AK49 rifles, Rocket Propelled Grenades (RPGs), Improvised Explosive Devices (IEDs), come for di operation.

Di IGP for di statement wey im tok tok person CP Frank Mba, release say “di attempt by di attackers to gain access to where Police dey keep dia weapons for di Headquarters fail as officers wey dey on duty no allow dem.

However, di place where Police dey keep dia weapons dey intact and di police no record an death apart from di Police constable wey sustain minor bullet wound for im shoulder.

“Di IGP don direct di Commissioner of Police, Imo State Command and one new Special Investigation Team (wey dem set up specifically to deal with cases of incessant attacks on security formation/operatives for di region), to carry out holistic investigations into di incident with di aim of to arrest di pipo wey carry out dia arrest.”

Wetin we sabi about Orlu trend for social media

Orlu ESN clash wit soldiers – Wetin we know so far

Protest dey shele for Owerri afta court comot Ihedioha as Imo Govnor

IPOB don challenge us, we go rise to di occasion – Gov. Uzodimma

Imo State Governor Hope Uzodimma don tok say government go rise to di challenge wey members of di proscribed Indigenous People of Biafra (IPOB) and Eastern Security Network (ESN) don carry come.

Governor Uzodimma tok dis one during im interview with tori pipo for Owerri after im inspect di level of damage wey happen for di attack.

Dis na di second major attack for Imo State this 2021 – On January 25, 2021, dis same gunmen carry attack go Orlu where dem kill some traders and soldiers.

Nigerian troops for one joint operation wey involve Army, Air Force and di Police carry fight go meet di armed IPOB members after in response to di Orlu incident.

But on top dis latest attack Governor Uzodimma say, “di level of gangsterism of IPOB and ESN members dey unacceptable. Pipo wey get conscience don condemn dis attack. I don already commission investigation into wetin happen for di incident.

“Wetin these boys wan do na to put fear for our pipo body and we no go allow dat one happen. We already know these pipo activities and e don dey increase. As tok before, government go rise to di occasion.

“Nobody die for di incident. Di lifeless body wey pipo think sey dem see na just one person wey dey unconscious because of di shock of the incident. Government dey collaborate with security agencies to ensure say dis kain tin no happen again.

Owerri attack

BBC

Gunmen attack prison for Owerri

Gunmen on Monday attack di Nigerian Correctional Services (NCS) for Owerri, Imo state capital for south east Nigeria.

According to tori, dis wan happun around midnight and e never clear if prisoners escape from di prison.

BBC Pidgin reporter wey dey ground dia say, dem shoot one inmate dead as e bin dey try to escape. About 30 vehicles na im di gunmen burn down inside di police headquarters wey dey di same area.

Di police headquarters dey opposite di Imo state government house.

E no dey clear who carry out di attack at di moment.

Dis no be di first time hoodlums dey attack prison officials and dia facility for Imo State.

Di Federal Prisons now Nigeria Correctional Centre, Owerri, wey dem originally build to accommodate 548 inmates, dey currently house over 1,700 inmates.

For 2016, one Henry Chibueze, also known as Vampire bin escape from Imo High Court premises following a shootout between gunmen and security operatives.

For dat incident, di gunmen open fire on di security operatives and inmates wey dey court premises with over 50 inmates from di prisons – though police later kill Vampire after one sting operation for 2017, armed gunmen still dey worry for Imo State with several attacks on police officers for different parts of di state.

James Madugba, tok-tok person for di Nigeria Correctional Centre, Imo State tell BBC say true-true di incident happen but never fit confirm whether some inmates escape or not.

“We never fit tell pipo exactly wetin happen, but wetin I fit talk be say be say, wen we don gather more information we go address media pipo,” Madugba tok.

See pictures from di attack:

Owerri prison

BBC
Owerri attack

BBC
Owerri attack

BBC
Building dem attack

BBC
Owerri prison

BBC
Building dem attack

BBC
Building wey dem attack

BBC