Soludo Attacked: Police gbab four say suspects don give more information

Soludo

Getty Images

Di Anambra State Police command don arrest four suspects wey allegedly get hand for di attack on former CBN Governor and govnorship aspirant, Professor Charles Soludo.

Toktok person for di Anambra Police Command, Ikenga Tochukwu say Mbah Victor, John Olisakwe, Chigozie Omeh and Emmanuel Nnobi na di suspects wey dem arrest.

Three Police Officers wey dem bin attach to Soludo die for di attack wey happen for di All Progressives Grand Alliance (APGA) aspirant village for Isuofia Civic Centre for Aguata local government area for Anambra State.

Di gunmen wey di police never know dia motive also kidnap di Commissioner for Public and Utilities, Engr Emeka Ezenwanne during di attack.

“Di suspects don confess to get hand actively for di attack and abduction of di Commissioner wey di Command dey work hard to rescue. We dey do everytin possible to catch oda members of di gang wey get hand for Professor Soludo attack,” Tochukwu tok for statement.

No group don claim responsibility for di attack but dis attack on di APGA govnorship aspirant dey happun as jaguda boys dey attack plus kill security agents especially police officers for South Eastern Nigeria.

Recently di Police High Command bin parade 16 suspects wey dem arrest for different parts of di region wey allegedly dey involved for di killing of officers and attack on Police Stations for South East.

Confamation of life immediately afta attack

Few hours afta di gunmen attack happun, di former CBN govnor confam to BBC say im dey fine.

Inside phone call wit BBC Igbo, Oga Soludo say im dey fine and notin do am, but add say even though notin do am, im no fit tok say im dey fine afta three of im security aide die for di attack.

Beyond confaming say im dey okay, Oga Soludo bin add say im neva fit tok much about wetin happun.

Inside di first statement wey police release afta di attack, di tok tok pesin, Ikenga, say dem kidnap oga Ezenwanne, nobody sabi wia im dey.