President Muhammadu Buhari London travels to treat Nigeria leader health

President Muhammadu Buhari of Nigeria dey take off to London for medical check up today.

Dat na di news Nigerians go wake up to on Tuesday afta di office of di president announce di United Kingdom [UK] trip last night.

Dis Buhari UK health care waka na di 12th time since im become president in 2015.

Femi Adesina wey announce President Buhari latest travel inside statement say di treatment go last for about two weeks.

Adesina add say di 78 year old leader go meet with di service chiefs [ogas at di top of di Armed Forces] before e go leave Abuja.

Di last time di Nigerian president depart Abuja go London na last year wen e go to participate for di first UK-Africa Investment Summit wey happun on 20 January, 2020.

However di last UK medical trip of di president happun on 25 April, 2019 wen di office of di president say di “private trip” to London,” go last for 10 days.

Tori be say di president dey regularly visit UK for one medical reason while hospitals inside di west African kontri still dey lack equipment and latest technology for treatment of any sickness.

Dis na di oda times Buhari do trip to UK

2016 Buhari UK trip

Eight months afta Muahmmadu Buhari become President of Nigeria – on February 5, 2016, e travel go UK for im first holiday and return on February 10, 2016.

From 13th to 15th May, 2016, Buhari attend first ever Anti-corruption summit inside di United Kingdom wey many heads of state from around Africa also show face.

6th to 19th July, 2016 Buhari go London on Sick leave.

2017 Buhari UK trip

7th May to 13th August 20, 2017 Buahri go London on sick leave {na during dis trip dem say rodents alias rats tave over di president office inside Aso Rock]

21 to 25th September, 2017 di 78 year old Nigerian leader take anoda trip to London on holiday.

2018 Buhari UK trip

9th to 19th April, 2018 Muhammadu Buhari enta London for meeting of Commonwealth Nations.

1st to 2nd May, 2018 oga Buhari go London on transit.

8th to 18th May, 2018, di Nigerian President visit London to see doctors.

3rd to 13th August, 2018 Buhari go London for holiday.

"Muhammadu Buhari London travels for United Kingdom medicine"

BBC

2019 Buhari UK trip

25th April to 5th May, 2019 President Buhari do private trip to London

Presido Muhammadu Buhari travel go United Kingdom for ‘private visit’ from 2nd till 17th November 2019.

2020 Buhari UK trip

Di Nigerian president depart Abuja go London to participate for di first UK-Africa Investment Summit wey happun on 20 January, 2020.

2021 Buhari UK trip

President Muhammadu Buhari of Nigeria go take off to London for medical check up on 30th March, 2021 for two weeks.

"Muhammadu Buhari London travels for United Kingdom medicine"

BBC

No public record in Nigeria don show who dey pay for all dis private visits of President Muhammadu Buhari.

Buhari UK trip funding fit dey come from Nigerian tax payers, but dat na informate BBC Pidgin never fit verify.

Di exact sickness or health challenge wey di 78 year old Katsina man dey always travel to UK to treat, no dey known publicly.

Both di goment of Nigeria, di president office and Buhari family keep di mata private.

United Kingdom, wey di three time Nigerian leader dey travel go for treatment, still dey on lockdown sake of coronavirus pandemic.