Otedola bridge fire: Accident of tankers burn vehicles for Lagos Otedola bridge

Otedola bridge fire burn down vehicles again for Lagos on Saturday morning, authorities don confirm.

Lagos State Fire and Rescue Service say one 45, 000-litre diesel tanker accident opposite di Otedola Estate main gate for cause one heavy fire but e destroy six oda motor.

Fire fighters don already prevent di tanker from burning, according to Margaret Adeseye, di state fire service acting controller.

But di main cause of di fire still dey under investigation.

Adeseye tok say di agency receive Fire alert on Saturday at about 0215 hours from di Otedola Bridge, Ojodu Local Council Development Area inside Lagos.

Di alert say some vehicles dey burn and so di agency take “action immediately and send two Fire Engines plus crew members to fight di situation”. 

Di oga for Lagos State Fire and Rescue Service explain say as dem reach di pace, dem find out say di fire don already affect two 45, 000-litre tankers wey carry Diesel, two flatbed trailers, one Mazda car and one container truck. She add say di fire fighting operations start immediately to stop di fire from causing more damage, an dem finally help prevent one 45,000 litres tanker from burning down.

Authorities day dem neva still know di cause of di fire as investigation dey go on.

Meanwhile di acting Head of di Fire Agency confam give tori pipo say nobody die for di fire incident.

Otedola bridge fire pictures: